Exola Play is currently on www.exola.net

Wetin You Need To Know About Nnamdi Kanu Court Today.

 


 

Appeal court wey dey ABUJA, Nigeria capital go hear di case of di proscribed indigenous people of Biafra (IPOB), leader Nnamdi Kanu case today.  Di appeal court hearing na to challenge di remaining seven count charges wey Federal govt sama di leader. For May 2022, Justice Binta Nyako of di Federal High Court remove some of the charges wey dem issue Nnamdi from 15 to 7. Di  matter so far be say di federal high court wy siddon for Abuja don dismiss di bail application of Nnamdi Kanu.

Di leader of di indigenous people of Biafra Nnamdi Kanu tok say di Biafra struggle na to fight for di pipo and not to kill di pipo of di region. Im still talk say im bin dey respond to di outcome of im bail application for di Federal High Court, wey dey Abuja for one interview afta im trial.

 

Di Seven-Count charges wey Nnamdi Kanu wan appeal

Count 1: Say Nnamdi Kanu as member and leader of IPOB commit act of terrorism against di federal republic of Nigeria by making broadcast wit intention to intimidate di population.

Count 2: Say Nnamdi Kanu as member and leader of IPOB commit act of terrorism against di Federal Republic of Nigeria by making broadcast wit intention to threaten members of di public wit sit at home order.

Count 3: Say Nnamdi Kanu make broadcast wia e declare imsef as member and leader of IPOB, group wey Nigeria goment don ban.

Count 4: Say Nnamdi Kanu make broadcast wia e encourage members of di public to kill Nigeria security officers.

Count 5: Say Nnamdi Kanu make broadcast wia e encourage di public to attack officers of di Nigeria police force.

Count 13: Say Nnamdi Kanu make broadcast wia e encourage members of di public to burn down evri federal goment facility for Lagos wey lead to major economic loss to federal goment.

Count 15: Say Nnamdi Kanu import Radio transmitter known as Tram 50L and hide am inside container for Ubulisiuzor for Ihiala Local government area of Anambra.

 

 

Comments