- Get link
- X
- Other Apps
My people, My people, omo una don hear!!!!
Reverend Chris Okotie wey be former presidential candidate, wey don contest several times to become di president of dem country Nigeria, wey also be d founder of household of God Church and him popular musician before e go into full time ministry tok say him never give up...
Him talk say " wen pipo dey tok about God, dem no understand the difference between bible...
Na inside d tori we still dy wen him talk say " no b say I stop, I no stop, na process by process na im we dy follow becoz the system wey we dey use no go work and him no wan join pdp or apc or any of dem big big party because if him join e go become one of di problem..na wetin reverend chris okotie tok...
We still dey on top d tori wen reverend chris tok say d presidential system of Govt wey nig dy operate , dem no dy use am well say dem need to set am aside...
Him say d Kain system dem dy use na partisanism because say na all about di party( govt of di party, by di party, for di party,) say dat one no be democracy...say d one wey him know na "govt of di pipo for d pipo...
On top the tori reverend chris tok say to carry out restructuring and constitutional change wey go solve nigeria big problem go require interim govt wey dy qualified to lead as d originator for english language of di 'Aboriginal Democracy' concept
- Get link
- X
- Other Apps

Comments
Post a Comment