- Get link
- X
- Other Apps
As di internal crisis wey dey rock di Nigeria main opposition party, di PDP dey worse, Rivers state govnor, Nyesom Wike continue continue to dey tok about why e no go gree make di National chairman of di party, Iyorchia Ayu remain.
For one media chat wey dem broadcast live for Port Harcourt on Friday, Wike dare di party to suspend am.
‘’If di party wan suspend me, no problem. I no ever say I big pass di party. But anytim you see you take. Dem know wetin I go do. Pikin wey say im mama no go sleep im sef no go sleep,’’
Wike deny say im dey do anti party.
''If you be asset, pipo must come and tok to you.'' E tok.
''If Ayu say im love dis party and want dis party to win di election, im know wetin to do.
Dis dey come days after Wike team bin pull out of di Atiku presidential campaign council.
‘PDP must prove say Nigerians fit trust Dem’
Wike say e dey important for di PDP to prove to Nigerians say dem fit trust dem with dia votes, if dem wan return dem to power in 2023.
E warn PDP not to take Nigerians for granted as dem already no dey happy with di failure of di All Progressives Congress (APC) led federal Goment.
Governor Wike point say di promise of hope by PDP to Nigerians dem must see am from how dem fit resolve di current leadership imbalance and marginalisation among dia members.
"You see, pipo like to take Nigerians for granted and dat na wetin PDP
dey try to do. Becos Nigerians no dey happy with APC so we as a party
must show to Nigerians say we get integrity, we dey trustworthy to do
wetin we don promise Nigerians so dat when we come, all dis issues of
marginalisation go be a thing of the past."
- Get link
- X
- Other Apps

Comments
Post a Comment