- Get link
- X
- Other Apps
Una Good Morning ooo...Na we dey give una latest news back to back. On top today tori b say Nigeria Presido wey be Muhammadu Buhari go visit
Imo State again on Tuesday for di second time under di current administration for di state.
Di presido comot on one one-day
working visit go commission some projects for di Southeast state on di invitation
wey Governor Hope Uzodinma give am.
Some of di commisssioned projects wey presido commission na di, dualized 36-kilometer wey dey for Owerri-Orlu road, di first phase of di dualized 53-kilometer wey dey Owerri-Okigwe road and di state house of assembly complex.
“As pipo dey tok for local Igbo parlance, a good road deserves a second passage. Na lovely coincidence say your govnor, “Uzodimma” wey come from dis same idiom. No wonder, you don make provision of good roads one of im top priorities,” na wetin president Buhari tok.
Di visit of President Buhari for Imo state coincide wit di day of di Appeal Court hearing of di leader of di proscribed Indigenous People of Biafra (IPOB), Nnamdi Kanu. Di secessionist group say pipo no come out.
For di sake of di sit at home wey dey happen for Imo State, many pipo no come out open dia shops, roads dey empty, and banks dey locked as residents of di state dey monitor di president visit from dia homes and through social media
- Get link
- X
- Other Apps


Comments
Post a Comment